Lyrics

Shey won shat si eh ni? Iya, orun mi da? Woo! (You this place is too hot o, abeg) get out from my way idiot Madam, let me have, let me have my food please (this food your food hot abeg, abeg) (O boy na wa o) let me have my food (Give me an extra plate before I break something here, ah-ah) (O boy this food sweet no be small o) This na one buker wey I dey like to go The food sweet sotey e go make you mind blow Day and night, Iya Bas, how she do am, I no know Dem think say na jazz, my brother, no be so People, people make una come o Iya Basira e don jazz me o, oh-oh-oh Everybody helep save me o I no dey sabi chop at my mother or my girlfriend's food People, people make una come o Iya Basira e go kill me o, oh-oh-oh Everybody helep save me o I no dey sabi chop at my mother or my girlfriend's food Long throat na food go kill you (no be so) I say na food go kill you (o-o-oga mi no be so) Weytin dey be say e get one day wey I say I go play go see my paddy Sunday Na so I reach there but Sunday e don high on beer Luckily for me him junior brother eye e clear He say make we stroll to the area Little did I know that I was strolling to my burial Right there where Oshodi bus dey load Was a little buker close to the main road I laugh when e pass the door E tell me say the name na Iya Bas for short But I bow when e order iresi ati ewa, ero mm-mm pure water not even mineral I come gree say I go manage to chop am Before I realize I dey order second round Third round, forth round, I never still stop Wetin Iya Basira e give me chop ehn? People, people make una come o (people) Iya Basira e don jazz me o, oh-oh-oh (e don jazz me o) Everybody helep save me o I no dey sabi chop at my mother or my girlfriend's food (mother or my girlfriend) People, people make una come o Iya Basira e go kill me o, oh-oh-oh (she go kill me my brother) Everybody helep save me o I no dey sabi chop at my mother or my girlfriend's food (eh-ehn) Long throat, na food go kill you (Ah! No be so) I know, I say na food go kill you (oga mi) You think say na play when I say na the way wey I dey (Wetin do am?) E no day okay Wetin be your own advice, I don dey steal my paddy money to buy Iya Basira rice Even on my girlfriend birthday Wey she dey wait make I take am to Ocean View I no know when I pass the place The only thing wey dey my mind na Iya basira palm oil stew Ah! Kilon, kilon shele, shele Me I never see this kind juju, telle telle All those wey go vex kpele kpele, but I hear say Iya Basira na (kpele kpele) I sure say still I go go there go sidown Order my first round move to second round Third round, fourth round I no dey ever stop Wetin Iya Basira come give me chop? Mo gbe People, people make una come o (people make una come o) Iya Basira e don jazz me o, oh-oh-oh (oti sun mi o) Everybody helep save me o (eh!) I no dey sabi chop at my mother or my girlfriend's food (eh!) People, people make una come o (I'm in trouble o) Iya Basira e go kill me o, oh-oh-oh (e gba mi o) Everybody helep save me o (abegi o) I no dey sabi chop at my mother or my girlfriend's food Officer abegi follow me to the place Everybody don telli me I dey craze My girlfriend don leave me My mother no gree see me My paddy mm! Iya Basira e don kill me Officer abegi follow me to the place Everybody don telli me I dey craze My girlfriend don leave me My mother no gree see me My paddy eey! Iya basira e don kill me (Oya people, people make una stop officer e don come) Where the woman? (Hin dey inside) (oga I dey come) Woman na wetin you dey give people chop Wey dey cause all this wahala, kasala oya make we talk (Oga sir, true to God, nothing wey I dey put for the food wey I dey cook) (Na God dey make am good) Na which kind talk be that Shey na God dey cook the food Abi you think say I be fool no be juju you dey put In fact, I dey suspect say na-, you wash put Sotey people dey queue come dey rush for your stew Well, to confirm am bring am make I chop small Give me fufu 90 naira plus that soup wey dey draw Chai correct! This food sweet no be small Shey una no go vex if I still order for more (Officer no worry na the food be this) (Oya people, people make una go, case dismiss!) People, people make una come o (mo gbe!) Iya Basira e don jazz me o, oh-oh-oh (e gba mi o) Everybody helep save me o I no dey sabi chop at my mother or my girlfriend's food People, people make una come o (Klint Da Drunk o) Iya Basira e don jazz me o, oh-oh-oh Everybody helep save me o (shey na me be this o) I no dey sabi chop at my mother or my girlfriend's food People make una come o (wahala) Iya Basira e don jazz me o, oh-oh-oh (this na palava) Everybody helep save me o (oh yea) I no dey sabi chop at my mother or my girlfriend's food (I dey hala, hala, hala) People, people make una come o Iya Basira e don jazz me o, oh-oh-oh Everybody helep save me o I no dey sabi chop at my mother or my girlfriend's food
Lyrics powered by www.musixmatch.com
instagramSharePathic_arrow_out