Lyrics

E.D.O BOIY Hehehe, Dem must hear pesin na, Oh God!!!! Ok E get this torey I for tell Pesin; NO NEED; I no sure say dem go hear Pesin .and if I dey church, I no like dey share testi- MONY!!! dem fit go talk say make I help Pesin Nowadays nobody dey fit dey send Pesin; Round about beggers Dey Dey Disrespect Pesin One minute u go see say dem dey beg Pesin; The next minute omo dem don begin shenk Pesin Oh my God dem must hear Pesin dem must hear Pesin dem must hear Pesin dem must hear Pesin! dem must hear... eh! dem must hear Pesin dem must hear aaay! dem must hear Pesin dem must hear Pesin dem must hear Pesin dem must hear Pesin dem must hear Pesin Guy! dem must hear Pesin dem gats hear Pesin dem must hear Pesin they have to hear Pesin 1; Now listen. Me I no too sabi beg Pesin; But at least if I broke, I suppose tell Pesin... Now the problem for this country be say If you beg Pesin for money, you go dey get this little self esteem Is that so, true or false? (True) No! No!! No!!! True or false? Answer me, make I clear Pesin. Why e be say Pesin no dey like dey help Pesin; We no be deaf and dumb but still we no dey hear Pesin!! OK see! E get this day when I go near Pesin; them be like 2 chiefs, the money wey them get plenty Na only transport fare I ask, shey I offend Pesin? Them wan con finish me with question wey fit wreck Pesin!! Dem be like; "hmmm, you don't even care to greet; where do u come from? The South or the west or east? Abi na north? The way u take stand here dey beg money What is your name, age and where do your parents live? Omo, chai! Before these people wreck Pesin; I ask my friend, Guy, wetin I go tell them chiefs? You know wetin the idiot tell me? The idiot say him no Maurinho, he no sabi defend Pesin!! Now listen... I don dey rap since the Genesis; and other rappers dey try catch up like Nemesis. Na me be don dada here cos I dey end Pesin; I no dey rap with one style, I get like 10 techniques I dey rap, I dey sing and I dey sell Pepsi; I dey sell sim card and I dey sell Chelsea... I don sell tire, things wey I dey sell plenty; Na small e remain I suppose don begin sell Pesin!! Plus I be hardcore rapper wey dey tear Pesin; now all these commercial rappers, dey don dey vex Pesin Cos if I show for inside club dey shark shekpe since; Commercial rappers go enter dey order Hennessy!!! E get this torey I for tell Pesin; NO NEED; I no sure say dem go hear Pesin .and if I dey church, I no like dey share testi- MONY!!! dem fit go talk say make I help Pesin Nowadays nobody dey fit dey send Pesin; Round about beggers Dey Dey Disrespect Pesin One minute u go see say dem dey beg Pesin; The next minute omo dem don begin shenk Pesin Oh my God dem must hear Pesin dem must hear Pesin dem must hear Pesin dem must hear Pesin! dem must hear... eh! dem must hear Pesin dem must hear aaay! dem must hear Pesin dem must hear Pesin dem must hear Pesin dem must hear Pesin dem must hear Pesin Guy! dem must hear Pesin dem gats hear Pesin dem must hear Pesin they have to hear Pesin 2; Oh my days I remember when I get bar and I dey spend em Gees; I turn coach sotey me I con dey bench Pesin I turn player and na shege all these girls dem see; na me be the only player wey no dey wear Jersey!!! Oh Lord! Money higher than your self esteem; and I dey sort bills even as the girls many I bet you'll never see a fella who could spend like me; Naso me dey take dey brag until I learn lesson ...So big shout out to the guys wey dey rep Pesin Gee boys wey dey work, dem no dey tell Pesin Now the Gbebò be say dem no sabi help Pesin; Only thing wey dem sabi na to dey flex person But Its all good, even as dem no dey help Pesin; at least dem go flex Pesin till ur head dirty Eff Pesin! Brain looking like a deaf Pesin; and at this point omo dem fit even sell Pesin!!!
Writer(s): Olamide Adedeji, Kelvin Obiojogwu, Forune Ibrahim Lyrics powered by www.musixmatch.com
instagramSharePathic_arrow_out