Music Video

Prince Nico Mbarga Sweet Mother
Watch {trackName} music video by {artistName}

Featured In

Credits

PERFORMING ARTISTS
Prince Nico Mbarga
Prince Nico Mbarga
Performer
Rocafil Jazz
Rocafil Jazz
Performer
COMPOSITION & LYRICS
Prince Nico Mbarga
Prince Nico Mbarga
Composer

Lyrics

Sweet mother, I no go forget you For this suffer wey you suffer for me Sweet mother, I no go forget you For this suffer wey you suffer for me When I dey cry, my mother go carry me, She go say my pikin weti you dey cry o yo Stop stop, stop stop, stop stop make you no cry again When I want sleep, my mother go pet me She go lie me well well for bed She cover me cloth, sing make you sleep Sleep sleep my pikin oh When I dey hungry, my mother go run up and down She dey find me something wey I go tchop oh Sweet mother, sweet mother oo When I dey sick, My mother go cry cry cry She go say instead when I go die, make she die oh She go beg God, "God help me, God help me, my pikin oh" If I no sleep, my mother no go sleep If I no chop, my mother no go tchop She no dey tired, Sweet mother I no go forget this suffer wey you suffer for me Sweet mother, éé sweet mother oo Sweet mother I no go forget this suffer wey you suffer for me. And if I fi forget you, therefore I forget my life. If you forget your mother, you've lost your life Sweet mother, I no go forget you For this suffer wey you suffer for me Sweet mother, I no go forget you For this suffer wey you suffer for me When I dey cry, my mother go carry me, She go say my pikin weti you dey cry yé yé Stop stop, stop stop, stop stop make you no cry again When I want sleep, my mother go pet me She go lie me well well for bed She cover me cloth, say make me sleep Sleep sleep my pikin oh When I dey hungry, my mother go run up and down She dey find me something wey I go tchop oh Sweet mother éé, sweet mother éé When I dey sick, My mother go cry cry cry She go say instead when I go die, make she die oh She go beg God, "God help me, God help me, my pikin oh" If I no sleep, my mother no go sleep If I no chop, my mother no go tchop She no dey tired, Sweet mother I no go forget this suffer wey you suffer for me yé yé Sweet mother, sweet mother You fit get another wife, you fit get another husband But you fit get another mother? No, at all. Sweet mother, I no go forget you For this suffer wey you suffer for me Sweet mother, sweet mother ...
Writer(s): Nico Mbarga Lyrics powered by www.musixmatch.com
instagramSharePathic_arrow_out