Lyrics

Abeg It's paper boy ah How e be A trip to the south men Na giro matter If I tell you my life How i take reach You no go believe Who dey there abeg bring chair One polo one jean Rotten palm sleepers 12yrs old I don stop to dey sleep house Ring the bell 12 'O' clock suppose to be break in time But wit me and gal wey omo Na taking time Tear people school bag Remove their belonging Big down I don't know what I fit call me Headphone for my ear One old walk man dey jam 2pac Of course I no get work Morning till night We dey area dey gamble, dey struggle Police fear, rush come wear us government bangle My role model that year Na dem bros okpe Na wen e die I know say na ole go le Community dey find us We dey bush dey cush Officer relax you never know who be the bush here If not for Jehovah My life would have been over Na baba God dey bless me o E dey bless me o E dey bless me I no be super man o But my life dey e hand o Na baba God dey bless me so E dey bless me o E dey bless me If not for Jehovah When I tell them my dream Dem go start to laugh Erigga relax who don blow with rap for waff Okere prison dey call You go soon join your boys But deep down I know say the world go hear my voice From street to street dey kpuff who talk say you dope Erigga good The problem be say you broke So when time reach to choose Bible or riffle I pick Bible Flown the back street with kpo Money start to enter I begin book section More music, more show, less police station No more police statement Now na account statement Call dem o boy Afa, how dem make that payment If not for Jehovah My life would have been over Na baba God dey bless me o E dey bless me o E dey bless me I no be super man o But my life dey e hand o Na baba God dey bless me so E dey bless me o E dey bless me If not for Jehovah Na the moral of the story Give up no join E fit dey hard na country man stay on point Fail to plan my brother Na plan to fail Who go better go better Na tey e dey tey No be stone you dey cook My brother na beans, when e done Tear everywhere like rugged jeans I don see men hammer, I don see men broke To the point dem no fit even buy gbana smoke Who belle full go hungry My brother wey you na brain Broke today Your men go throway you Money dey, but I dey grind like upcoming Anything wey make me fall E no go funny at all men If not for Jehovah My life would have been over Na baba God dey bless me o E dey bless me o E dey bless me I no be super man o But my life dey e hand o Na baba God dey bless me so E dey bless me o E dey bless me If not for Jehovah The end
Lyrics powered by www.musixmatch.com
instagramSharePathic_arrow_out