Listen to Head Pan (feat. Prinx Emmanuel) by Erigga

Head Pan (feat. Prinx Emmanuel)

Erigga

Hip-Hop/Rap

Lyrics

Make you wise up oh brother Make you rise up from your slumber The truth be say, nobody send you Every aboki man with kettle That your chairman fit no help you Everybody get him own issue yeah, yeah If you no wan use that your head pan Everyday you dey walk about Owo go be your badman oh If you no wan use that your head pan Everyday you dey walk about Owo go be your badman oh That's why, I've never been the type to judge people That's why I don't roll with world people, ah For outside the universe so, they fit allow me pass But they furukpe the vow, my dream, they must cripple Wetin I do them? (I tire) Abi na crime to help your people? Same people when dey claim they be my people When dey your back, na him wan push me inside pit hole Na once I throw backi leave them, Jackie Chan Jonzing men, they no know wetin God dey plan? Eighty percent of them when dey my Instagram no like me Na story them dey find to yarn I don forgive you, hope you fit forgive yourself? Na you conscience go worry, I dey here kpeff Middle finger to una when carry my matter put for head How far, head no dey pain una, wetin? Make you wise up oh brother Make you rise up from your slumber The truth be say, nobody send you Every aboki man with kettle That your chairman fit no help you Everybody get him own issue yeah, yeah If you no wan use that your head pan Everyday you dey walk about Owo go be your badman oh If you no wan use that your head pan Everyday you dey walk about Owo go be your badman oh I like you Plus you na my man But your doings this days, I no understand Real matter, no dey do head like coco yam Wetin dey sup? Enter motor make we yarn Every morning you wake up, Tunde Ednut page Jonzing man, them swear for you with give away? Your mate dey buy Benz, you dey call them ritualist Dey judge them, waka round, area publicist Person like you fit carry red paint for night Around two for your paddi gate dey write "This building is under investigation by EFCC" Next thing, your paddi don take flight Ede erunkaye, na im Ibori call them Why you dey bless am pass me, na im be their problem Your see this music I dey hustle, na im be my head pan Na im make I carry am for head, I tell you that year for Ekpa na, shuu If you no wan use that your head pan Everyday you dey walk about Owo go be your badman oh If you no wan use that your head pan Everyday you dey walk about Owo go be your badman oh
Lyrics powered by www.musixmatch.com
instagramSharePathic_arrow_out