Listen to Situation Room (feat. Brenny Jones) by Erigga

Situation Room (feat. Brenny Jones)

Erigga

Hip-Hop/Rap

Lyrics

Abeg Paper, Paperboi 2019 mhen, how e be? (Brenny Jones ti de o) I wan give you story now from the situation room (King Paper) How e take happen for area real, real Just now, just now here e never too tey I be ghetto boy and I like to chop money (chop money there) Iji ego, I like too much money I still like dem type Adeleke money (Adeleke money) Plus Otedola, all that kind money (biggie biggie money) Oh, (kpakam) If I make this money (kpakam) I go buy full Lekki (kpakam) If I make this money (kpakam) I go buy Ferrari (kpakam) If I make this money (kpakam), (eh ehn guy how far?) I go flex my mama (kpakam), (that matter wey I say I wan clear you) If I make this money (kpakam), (eh ehn na this so ma just clear you now for this yarn) I go spend this money E get one matter when play You know my guy Sparko? That my tall, black guy when dey stay airport road No be small matter happen for area o As I dey follow you talk dey yarn, four person don go Dem say dem get one transaction wen be say dem do Abi na one million dollars when dem say somebody chew The matter be say, the guy dey work client tey Na im make dem run money for the client, make she pay When money finish, dem wan come die the money For this small Warri, dem wan guy the smallie Some kind brah for the area, dem be deadly No need to give dem money, buy two Benelyne Dem don enter motor dey go find the pick up Two kala cut to size, all of them kit up One dey hurry so tey e cock him gun down Enter speed breaker, he mistakenly gun him own man for front seater Driver don confuse Don turn him hand, no dey face road The kind trailer when jam dem comot Na those kind trailer when-when dey carry load Oh, (kpakam) If I make this money (kpakam) I go buy full Lekki (kpakam) If I make this money (kpakam) I go buy Ferrari (kpakam) If I make this money (kpakam) I go flex my mama (kpakam) If I make this money (kpakam) I go spend this money So I pray, I pray gan-gan I pray, I pray So one day, one day, one day Hustle go pay, e go pay, I pray Oluwa I dey pray For this life ehn, no be who get money now get money You no know all those bank gate men? You know how much dem get when them dey their twenties? You go hustle after you say your morning Amen Four of them laugh, them dey drive dey go Dey reason life, some of them don spark their kpo Dey think wetin dem go do once the money show One say music, the rest say na ashawo Or go downtown buy all their men ibo You no fit blame them, na the only thing when them know Na there one say "po-po fit dey around" So e cock, e cock, e cock e kala down Be like say the nose face the guy for front sit See police for front, the guy halla "shit" (Oh shit!) Him no see the speed breaker, him jam am kpoo Accidental discharge, he own man kpoof Before now him say If he make this money, kpakam Him go buy Bugatti, kpakam Him go take the money kpakam Buy everything, kpakam Before him hear gbagaun The man don go, where him take gbagam Him no believe him Bible So I pray, I pray gan-gan (na real matter) I pray, I pray (confirm matter, legit matter) So one day, one day, one day (omo na prayer matter) Hustle go pay, e go pay (abeg) I pray (spiritual) Oluwa I dey pray We dey pray Oluwa Untimely death no be our portion Give us e.t.c money oh Money wey no get finish, fete rise, fetera type of money Na so e just be mhen I fit carry you reach the water But na for you to learn how to swim Motivate yourself
Writer(s): Gabriel Adebayo, Erhiga Agariube Lyrics powered by www.musixmatch.com
instagramSharePathic_arrow_out