Listen to Family Ties (feat. Oga Network & Igosave) by Erigga

Family Ties (feat. Oga Network & Igosave)

Erigga

Hip-Hop/Rap

Lyrics

My mommy say my son you know the Devil If no be open eye e for still dey for Heaven E no like number 2, e want to high e level But today, e no know dy among them when dey for Heaven Solution to problem no dey for bottle of beer You sure say no be dream when we dey for here You sure say one day person no go wake for there Because watin I dey see dey make me over fear And this is not a storybook Teacher don teach you You like you learn, you like you look But no go turn the fish when chop the worm swallow the hook Because when you go dey drag na Corner we go dey dey look If na only food wey dey make you come around E no good oh If na only food wey dey make you come around E no good oh If trouble dey work dey make u try dey come around Make you show your neighbor love cos e no good oh If na only food wey dey make you come around E no good oh Abeg Yo Why e be say na only when I post better thing Nai yu dey come around say boss give me something Screenshot your account dey send me But when better money dey inside you no dey send me (Greedy people) Why e be say we no fit share update (Why) Why e be say you don dey change off-late (Why) You no dey give unless say na babe Na you no get but na you still do giveaway You say hi I say hi next thing na account Senior man your loyal girl dey here dey mount After honorable don shift your pant Why you no play my music for am turn am to my fan So he fit dey help me the way e dey help you But you no go ever gree greedy girl fuck you Urgent 2k kill you there you dare write me again In fact I don block you If na only food wey dey make you come around E no good oh If na only food wey dey make you come around E no good oh If trouble dey work dey make u try dey come around Make you show your neighbor love cos e no good oh If na only food wey dey make you come around E no good oh The last control you go them give you 1 meter You pocket am for knicker you no tell Anita You still come her house come thief her hair Wicked girl no be you get 2 million there All this thing just remind me of my jazzman I go e house for Ijebu na my pastor I jam E wan hide I say no need I understand No be only you naim things dey hard Na the day I do for you I be better person The day I no do, "leave am na yeye person" Before you ask, ask watin you don do for me Give man pass watin e deserve e go dy act funny If na only food wey dey make you come around E no good oh If na only food wey dey make you come around E no good oh If trouble dey work dey make u try dey come around Make you show your neighbor love cos e no good oh If na only food wey dey make you come around E no good oh See my clothes naa this life no balance oh You no understand? Nothing dey this thing way people dey talk oo Naa fight I dey separate since Two independent woman dey fight for man Ahh-ahh-ahh
Lyrics powered by www.musixmatch.com
instagramSharePathic_arrow_out