Lyrics

Omo them say we no go blow if we no be lagos boy OK me I like to ball but no shi shi for my wallet Freestyle for instagram e put no shi shi for my pocket The boy too sabi na so dem dey tell me Snazzy no worry you go blow shey na so people dey tell me But the talent wey you see e no really matter If money no dey talent dey waste you know the matter Kill the show back to back you suppose know how the matter be Na so people dey hail me but the hailings no dey pay my bills Dem say i no go blow if i no be Lagos boy That na why I dey ask if M.I Abaga na Lagos boy Snazzy to the world no be today me i dey talk am The boy must to blow no be power na Oluwa talk am God abeg na which day my blessing go shower E don too dey tey if na egusi soup e for don sour I need to be a mane i like to ball like salah make Dem hear me world wide abeg make I song cause wahala But no wahala sha if you no reason me this year Lord who I'm I to say no when you say yes But e no go bad at all if you reason me this year The blessing don too dey tey na i no fit wait for next year Oluwa bless me on time make I no misbehave I dey on my kneels dey pray make i no feel the wind Many don come o na so many don go away But no be all wey come last long before they go away Oluwa abeg wetin dey occur listen to my prayers make you concur I always wan dey come first i no wan dey come forth But if i get a billion dollar I go dey comfort God abeg na which day my blessing go shower Snazzygrin na my name jor E don too dey try if na egusi soup e for don sour I need to be a mane i like to ball like salah Make dem hear me world wide abeg make I song cause wahala
Lyrics powered by www.musixmatch.com
instagramSharePathic_arrow_out